1 João 5
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT
1 Anybody wey bilive sey na Jesus bi Christ, don bi God pikin and anybody wey love di Papa, love di pikin wey E born.
1 Todo aquele que crê que Jesus é o Cristo é nascido de Deus. E todo aquele que ama o Pai também ama os filhos dele.
2 Wi go know sey wi love God shidren, wen wi love God and obey en kommandment.
2 Sabemos que amamos os filhos de Deus se amamos a Deus e obedecemos a seus mandamentos.
3 To love God, na to keep en kommandment and en kommandment nor dey hard.
3 Amar a Deus significa obedecer a seus mandamentos. E seus mandamentos não são difíceis.
4 Anybody wey bi God pikin, don win di world and na awa faith bi di pawa wey win di world.
4 Pois todo aquele que é nascido de Deus vence este mundo, e obtemos essa vitória pela fé.
5 Pesin wey bilive sey Jesus Christ na God Pikin, don win di world.
5 Quem vence a batalha contra o mundo? Somente quem crê que Jesus é o Filho de Deus.
6 Na Jesus Christ kom dis world with wota and blood. Nor bi only with wota, but na with di wota and di blood. And God Spirit bear witness sey dis na true, bikos na God Spirit bi di trut.
6 Jesus Cristo foi revelado por meio de seu batismo na água e pelo derramamento de seu sangue; não só por meio da água, mas pela água e pelo sangue. E o Espírito, que é a verdade, o confirma com seu testemunho.
7 Wi get three witness to show sey wetin wi dey tok, na true and dem bi:
7 Temos, portanto, três testemunhas,
8 God Spirit, di wota and di blood and dis three witness dey tok di same tin.
8 o Espírito, a água e o sangue, e as três concordam entre si.
9 If wi gri sey wetin human being tok na true, den wetin God tok about en pikin, naim big pass.
9 Porque cremos em testemunho humano, certamente podemos crer no testemunho de Deus, que tem ainda mais valor. E Deus dá testemunho acerca de seu Filho.
10 (Di pesin wey bilive God Pikin, go know inside ensef sey, dis tin na true, but pesin wey nor bilive God, dey sey God dey lie, bikos e nor bilive wetin God tok about en Pikin).
10 Quem crê no Filho de Deus sabe, em seu coração, que esse testemunho é verdadeiro. Quem não crê nisso, na realidade, chama Deus de mentiroso, porque não crê no testemunho de Deus acerca de seu Filho.
11 Dis na wetin God tok: God don give us life wey nor dey end and dis life dey inside en Pikin.
11 E este é o testemunho: Deus nos deu vida eterna, e essa vida está em seu Filho.
12 Anybody wey get di Pikin, get di life wey nor go end, but doz wey nor know God Pikin, go die.
12 Quem tem o Filho tem a vida; quem não tem o Filho de Deus não tem a vida.
13 I don rite all dis tins give una wey bilive God Pikin, so dat una go know sey una get life wey nor go end.
13 Escrevi estas coisas a vocês que creem no nome do Filho de Deus para que saibam que têm a vida eterna.
14 Na dis tins dey make awa mind strong anytime wey wi kom meet God: bikos if wi ask am for anytin wey dey good for en eye, E go give us.
14 Estamos certos de que ele nos ouve sempre que lhe pedimos algo conforme sua vontade.
15 And if wi know sey E dey hear us, den wi bilive sey wi go get di tins wey wi ask from am.
15 E, uma vez que sabemos que ele ouve nossos pedidos, também sabemos que ele nos dará o que pedimos.
16 If anybody si en broda or sista for Christ dey kommit sin wey nor go kill-am, make e ask God and God go give life to dat pesin. E get di kind sin wey dey kause deat and I nor sey make una pray make God forgive di pesin wey dey kommit dat kind sin.
16 Se alguém vir um irmão cometer pecado que não leva à morte, ore por ele, e Deus dará vida a esse irmão que pecou de maneira que não leva à morte. Mas há pecado que leva à morte, e não digo que se deva orar por aqueles que o cometem.
17 Evritin wey nor good for God eye, na sin, but e get di sins wey nor dey kause deat.
17 Toda injustiça é pecado, mas nem todo pecado leva à morte.
18 Wi know sey anybody wey bi God pikin, nor dey like to sin, but God dey keep en pikin, so dat devil nor go fit tosh am.
18 Sabemos que os nascidos de Deus não vivem no pecado, pois o Filho de Deus os protege e o maligno não os toca.
19 Wi know sey wi bi God shidren and dis world wey wi dey so, na wiked pipol dey rule am.
19 Sabemos que somos filhos de Deus e que o mundo inteiro está sob o controle do maligno.
20 Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.
20 E sabemos que o Filho de Deus veio e nos deu entendimento para que conheçamos ao Deus verdadeiro. Agora, vivemos em comunhão com o Deus verdadeiro, porque vivemos em comunhão com seu Filho, Jesus Cristo. Ele é o Deus verdadeiro e é a vida eterna.
21 So my shidren, make una make sure sey una nor get anytin to do with oda gods.
21 Filhinhos, afastem-se dos ídolos.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 João 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.