1 João 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 My friends, make una nor bilive evribody wey sey na God Spirit dey tok thru am. Una must test am to know weda na God Spirit e really get. Bikos many fake profets dey for dis world.
1 Caríssimos, não deis fé a qualquer espírito, mas examinai se os espíritos são de Deus, porque muitos falsos profetas se levantaram no mundo.
2 Dis na how una go take know God Spirit: If pesin bilive sey na Jesus bi di Mezaya, wey kom as human being, dat pesin get God Spirit.
2 Nisto se reconhece o Espírito de Deus: todo espírito que proclama que Jesus Cristo se encarnou é de Deus;
3 But evribody wey nor gri sey Jesus na Oga God, dat pesin spirit nor kom from God. Dat na di anti-Christ spirit wey una hear sey dey kom and e don already dey dis world.
3 todo espírito que não proclama Jesus esse não é de Deus, mas é o espírito do Anticristo de cuja vinda tendes ouvido, e já está agora no mundo.
4 My shidren, una kom from God and una don get viktory ova doz pipol, bikos di pesin wey dey inside una, big pass di pesin wey dey di world.
4 Vós, filhinhos, sois de Deus, e os vencestes, porque o que está em vós é maior do que aquele que está no mundo.
5 Dem kom from dis world: so dem dey tink like pipol for di world and di pipol wey dey di world, dey listin to dem.
5 Eles são do mundo. É por isto que falam segundo o mundo, e o mundo os ouve.
6 Wi kom from God and di pesin wey know God dey listin to us, but pesin wey nor know God, nor dey gri with us. Dis na how wi take dey know di thru Spirit and di spirit wey dey deceive pipol.
6 Nós, porém, somos de Deus. Quem conhece a Deus, ouve-nos; quem não é de Deus, não nos ouve. É nisto que conhecemos o Espírito da Verdade e o espírito do erro.
7 My friends, make wi love one anoda, bikos love kom from God and anybody wey love odas, na God pikin and e know God,
7 Caríssimos, amemo-nos uns aos outros, porque o amor vem de Deus, e todo o que ama é nascido de Deus e conhece a Deus.
8 but pesin wey nor love en broda nor know God, bikos God na love.
8 Aquele que não ama não conhece a Deus, porque Deus é amor.
9 Dis na how God love dey show for awa life: God send en only Pikin wey E born, make e kom dis world, so dat thru am, wi go get life wey nor dey end.
9 Nisto se manifestou o amor de Deus para conosco: em nos ter enviado ao mundo o seu Filho único, para que vivamos por ele.
10 Na dis bi love: nor bi sey wi first love God, but na-im first love us wen E send en Pikin kom die for us as sakrifice wey make am forgive us awa sins.
10 Nisto consiste o amor: não em termos nós amado a Deus, mas em ter-nos ele amado, e enviado o seu Filho para expiar os nossos pecados.
11 My friends, if God love us like dis, den wi must love each oda.
11 Caríssimos, se Deus assim nos amou, também nós nos devemos amar uns aos outros.
12 Nobody don ever si God before. If wi love each oda, God dey inside us and en love dey pafet inside us.
12 Ninguém jamais viu a Deus. Se nos amarmos mutuamente, Deus permanece em nós e o seu amor em nós é perfeito.
13 God don give us en Spirit to show sey wi dey inside am and e dey inside us.
13 Nisto é que conhecemos que estamos nele e ele em nós, por ele nos ter dado o seu Espírito.
14 Wi don si with awa eye sey, di Papa send en Pikin to bi Savior for di world.
14 E nós vimos e testemunhamos que o Pai enviou seu Filho como Salvador do mundo.
15 If anybody sey Jesus na God Pikin, dat show sey, God dey inside am and e dey inside God too.
15 Todo aquele que proclama que Jesus é o Filho de Deus, Deus permanece nele e ele em Deus.
16 Wi know and bilive sey, God love us and en love dey inside us.
16 Nós conhecemos e cremos no amor que Deus tem para conosco. Deus é amor, e quem permanece no amor permanece em Deus e Deus nele.
17 And as wi dey stay inside God, awa love dey grow more-more. So wi nor go fear for judgement day, but wi go face God with konfident, bikos wi live like Jesus Christ wen wi dey di world.
17 Nisto é perfeito em nós o amor: que tenhamos confiança no dia do julgamento, pois, como ele é, assim também nós o somos neste mundo.
18 Dis kind love nor get fear, bikos betta love dey drive fear komot from pesin heart. If wi dey fear bikos wi nor wont make God ponish us, dat show sey wi neva really know how en love bi.
18 No amor não há temor. Antes, o perfeito amor lança fora o temor, porque o temor envolve castigo, e quem teme não é perfeito no amor.
19 Bikos God first love us, naim make us dey fit love each oda.
19 Mas amamos, porque Deus nos amou primeiro.
20 If somebody sey, “I love God” and e hate en Christian broda, e dey lie, bikos pesin wey nor love en Christian broda wey e dey si, how e wont take love God wey e nor dey si?
20 Se alguém disser: Amo a Deus, mas odeia seu irmão, é mentiroso. Porque aquele que não ama seu irmão, a quem vê, é incapaz de amar a Deus, a quem não vê.
21 God don kommand us sey: “If anybody love mi, make e love en broda and sista for Christ too.”
21 Temos de Deus este mandamento: o que amar a Deus, ame também a seu irmão.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 João 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.