1 João 3
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 Make una si di kind love wey awa God get for us. And naw, pipol dey koll us God shidren and true-true, na God shidren wi bi. Di world nor know us, bikos dem nor know am.
1 Vede que grande amor nos tem concedido o Pai: que fôssemos chamados filhos de Deus; e nós o somos. Por isso o mundo não nos conhece; porque não conheceu a ele.
2 My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.
2 Amados, agora somos filhos de Deus, e ainda não é manifesto o que havemos de ser. Mas sabemos que, quando ele se manifestar, seremos semelhantes a ele; porque assim como é, o veremos.
3 And evribody wey get dis hope for Christ, dey make ensef pure, just as Jesus dey pure.
3 E todo o que nele tem esta esperança, purifica-se a si mesmo, assim como ele é puro.
4 Evribody wey dey like to sin, nor dey obey God law and to sin, na to disobey God law.
4 Todo aquele que vive habitualmente no pecado também vive na rebeldia, pois o pecado é rebeldia.
5 And una know sey God send Jesus kom, make e for karry sin komot and know sin dey inside Christ.
5 E bem sabeis que ele se manifestou para tirar os pecados; e nele não há pecado.
6 Anybody wey dey stay inside am nor dey like to sin, but pesin wey dey kommit sin, neva si or know am.
6 Todo o que permanece nele não vive pecando; todo o que vive pecando não o viu nem o conhece.
7 So my shidren, make una nor let anybody deceive una: If pesin dey do wetin good for God eye, dat show sey dat pesin dey good, just as Christ dey good for God eye.
7 Filhinhos, ninguém vos engane; quem pratica a justiça é justo, assim como ele é justo;
8 But pesin wey dey like to sin, na devil pikin, bikos devil dey sin from di biginnin. Na dis one make God Pikin kom dis world, so dat e go skata all di work wey devil dey do.
8 quem comete pecado é do Diabo; porque o Diabo peca desde o princípio. Para isto o Filho de Deus se manifestou: para destruir as obras do Diabo.
9 Pesin wey bi God pikin, nor dey like to sin, bikos God seed dey inside am.
9 Aquele que é nascido de Deus não peca habitualmente; porque a semente de Deus permanece nele, e não pode continuar no pecado, porque é nascido de Deus.
10 Na like dis una go take know God and devil shidren. Pesin wey nor dey do wetin good for God eye and nor love en broda or sista for Christ, nor bi God pikin.
10 Nisto são manifestos os filhos de Deus, e os filhos do Diabo: quem não pratica a justiça não é de Deus, nem o que não ama a seu irmão.
11 Dis na di Good News wey una don hear from di biginnin sey, “Make wi love each oda as awasef.”
11 Porque esta é a mensagem que ouvistes desde o princípio, que nos amemos uns aos outros,
12 Nor bi like Kain wey bi devil pikin, wey kill en broda. And wetin make am kill-am? Na bikos God nor asept en ofrin as E asept Abel own.
12 não sendo como Caim, que era do Maligno, e matou a seu irmão. E por que o matou? Porque as suas obras eram más e as de seu irmão justas.
13 So my brodas and sistas, make una nor sopraiz sey dis world pipol hate una.
13 Meus irmãos, não vos admireis se o mundo vos odeia.
14 Wi know sey wi don cross from deat enter life, bikos wi dey love and kare for awa brodas and sistas for Christ.
14 Nós sabemos que já passamos da morte para a vida, porque amamos os irmãos. Quem não ama permanece na morte.
15 Pesin wey hate en broda or sista for Christ, fit kill pesin and di life wey nor go end, nor dey inside am.
15 Todo o que odeia a seu irmão é homicida; e vós sabeis que nenhum homicida tem a vida eterna permanecendo nele.
16 Dis na wetin make us know wetin love bi: Jesus Christ die for us, so wi suppose sakrifice awa life for awa fellow Christian brodas and sistas.
16 Nisto conhecemos o amor: que Cristo deu a sua vida por nós; e nós devemos dar a vida pelos irmãos.
17 But pesin wey get enough tins and e nor sorry for en broda or sista for Christ wey nor get at-all, na how God love go take dey inside am?
17 Quem, pois, tiver bens do mundo, e, vendo o seu irmão necessitando, lhe fechar o seu coração, como permanece nele o amor de Deus?
18 My shidren, make wi nor dey love with only word for mout, but make wetin wi dey do, show sey wi really love each oda.
18 Filhinhos, não amemos de palavra, nem de língua, mas por obras e em verdade.
19 Wetin wi dey do go show sey wi dey live for di trut, so wi go dey bold wen wi stand for God present.
19 Nisto conheceremos que somos da verdade, e diante dele tranqüilizaremos o nosso coração;
20 So, even if awa mind kondemn us, wi know sey God big pass awa mind and E know evritin.
20 porque se o coração nos condena, maior é Deus do que o nosso coração, e conhece todas as coisas.
21 My friends, if awa mind nor kondemn us, awa heart go strong for God present
21 Amados, se o coração não nos condena, temos confiança para com Deus;
22 and anytin wey wi ask from am, E go give us, bikos wi dey do wetin E wont and na dis tins dey make belle sweet am.
22 e qualquer coisa que lhe pedirmos, dele a receberemos, porque guardamos os seus mandamentos, e fazemos o que é agradável à sua vista.
23 Na wetin E kommand bi dis, “Make wi bilive en pikin Jesus Christ name and make wi love each oda, even as E don kommand us.”
23 Ora, o seu mandamento é este, que creiamos no nome de seu Filho Jesus Cristo, e nos amemos uns aos outros, como ele nos ordenou.
24 So anybody wey do all wetin God tok, dey inside am and God dey inside dat pesin too. Wi know sey E dey inside us, bikos di Spirit wey E give us, dey stay inside us.
24 Quem guarda os seus mandamentos, em Deus permanece e Deus nele. E nisto conhecemos que ele permanece em nós: pelo Espírito que nos tem dado.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 João 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.