1 João 2
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 (My shidren, I dey rite about dis matter, so dat una nor go dey sin.) But if anybody sin, wi get pesin wey dey beg di Papa for us, dat pesin, na Jesus Christ wey dey raitious
1 Meus filhinhos, estas coisas vos escrevo, para que não pequeis; mas, se alguém pecar, temos um Advogado para com o Pai, Jesus Cristo, o justo.
2 and na en ensef bi di sakrifice wey God nid to forgive us awa sins. Nor bi only awa sin, but di sin wey di whole world dey kommit.
2 E ele é a propiciação pelos nossos pecados, e não somente pelos nossos, mas também pelos de todo o mundo.
3 Wen wi do wetin God sey make wi do, den wi go dey sure sey wi know am.
3 E nisto sabemos que o conhecemos; se guardamos os seus mandamentos.
4 Di pesin wey sey, “I know God” and e nor dey do wetin God tok, dat pesin dey lie and di trut nor dey inside am.
4 Aquele que diz: Eu o conheço, e não guarda os seus mandamentos, é mentiroso, e nele não está a verdade;
5 But anybody wey do wetin dem rite for God word, true-true, God word really dey inside am. Na dis go make us know sey wi dey inside God.
5 mas qualquer que guarda a sua palavra, nele realmente se tem aperfeiçoado o amor de Deus. E nisto sabemos que estamos nele;
6 Di pesin wey sey en with God dey togeda forever, dat pesin suppose live en life as Christ live en own.
6 aquele que diz estar nele, também deve andar como ele andou.
7 Una wey bi my friends, I nor dey rite new kommandment give una, na di old one wey una get from di biginnin, I still dey rite and una don hear dem before.
7 Amados, não vos escrevo mandamento novo, mas um mandamento antigo, que tendes desde o princípio. Este mandamento antigo é a palavra que ouvistes.
8 But dis new kommandment wey I dey rite give una so, naim bi di trut wey dey show inside Christ and inside una, bikos darkness don pass and di real lite don dey shine.
8 Contudo é um novo mandamento que vos escrevo, o qual é verdadeiro nele e em vós; porque as trevas vão passando, e já brilha a verdadeira luz.
9 Pesin wey sey e dey inside di lite, but e still hate en broda or sista for Christ, dat pesin still dey inside darkness.
9 Aquele que diz estar na luz, e odeia a seu irmão, até agora está nas trevas.
10 Pesin wey love en broda or sista for Christ, dey live inside di lite and nor-tin go make am fall.
10 Aquele que ama a seu irmão permanece na luz, e nele não há tropeço.
11 But di one wey hate en broda or sista for Christ, dey for darkness and e nor know where e dey go, bikos darkness don blind en eye.
11 Mas aquele que odeia a seu irmão está nas trevas, e anda nas trevas, e não sabe para onde vai; porque as trevas lhe cegaram os olhos.
12 My shidren, I dey rite give una sey God don forgive una sins, bikos of Jesus name.
12 Filhinhos, eu vos escrevo, porque os vossos pecados são perdoados por amor do seu nome.
13 I dey rite give una wey bi papa, bikos una know di pesin wey dey alive since God kreate di world. I dey rite give una wey bi yong pipol, bikos una don win Satan.
13 Pais, eu vos escrevo, porque conheceis aquele que é desde o princípio. Jovens, eu vos escrevo, porque vencestes o Maligno.
14 I don rite give una, my shidren, bikos una don know God. I don rite give una wey bi papa, bikos una don know di pesin wey dey alive since God kreate di world. I don rite give una yong pipol, bikos una dey strong and God word dey inside una, as una don win Satan.
14 Eu vos escrevi, meninos, porque conheceis o Pai. Eu vos escrevi, pais, porque conheceis aquele que é desde o princípio. Eu escrevi, jovens, porque sois fortes, e a palavra de Deus permanece em vós, e já vencestes o Maligno.
15 Make una nor love dis world or di tins wey dey inside am. If anybody love dis world, di Papa love nor dey inside am,
15 Não ameis o mundo, nem o que há no mundo. Se alguém ama o mundo, o amor do Pai não está nele.
16 bikos evritin wey dey inside di world (tins wey human being body wont; tins wey dey hongry pesin to get and to dey karry body up), nor kom from di Papa, but na dis world dem from kom.
16 Porque tudo o que há no mundo, a concupiscência da carne, a concupiscência dos olhos e a soberba da vida, não vem do Pai, mas sim do mundo.
17 And dis world don dey fade with di tins wey pipol wont, but di pesin wey dey do wetin God wont, go dey forever.
17 Ora, o mundo passa, e a sua concupiscência; mas aquele que faz a vontade de Deus, permanece para sempre.
18 My shidren, di world don dey end and just as una hear sey, anti-Christ dey kom, make una know sey many anti-Christ don already kom. And dis show us sey di world go soon end.
18 Filhinhos, esta é a última hora; e, conforme ouvistes que vem o anticristo, já muitos anticristos se têm levantado; por onde conhecemos que é a última hora.
19 Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.
19 Saíram dentre nós, mas não eram dos nossos; porque, se fossem dos nossos, teriam permanecido conosco; mas todos eles saíram para que se manifestasse que não são dos nossos.
20 But di pesin wey dey holy, don anoint una and all of una know sey na true.
20 Ora, vós tendes a unção da parte do Santo, e todos tendes conhecimento.
21 I nor rite give una, bikos una nor know di trut, but na bikos una know Christ and di trut dey stay inside am.
21 Não vos escrevi porque não soubésseis a verdade, mas porque a sabeis, e porque nenhuma mentira vem da verdade.
22 Na who dey lie? Na di pesin wey sey Jesus nor bi di Mezaya! Di pesin wey rijet di Papa and en Pikin, na Christ enemy.
22 Quem é o mentiroso, senão aquele que nega que Jesus é o Cristo? Esse mesmo é o anticristo, esse que nega o Pai e o Filho.
23 Anybody wey rijet di Pikin, nor get di Papa. But if pesin asept di Pikin, e don asept di Papa too.
23 Qualquer que nega o Filho, também não tem o Pai; aquele que confessa o Filho, tem também o Pai.
24 As for una, wetin una don hear from di biginnin, make una let am stay inside una. If wetin una hear from di biginnin stay inside una, una go stay inside di Pikin and en Papa.
24 Portanto, o que desde o princípio ouvistes, permaneça em vós. Se em vós permanecer o que desde o princípio ouvistes, também vós permanecereis no Filho e no Pai.
25 Dis na di promise wey Christ ensef promise us sey, di life wey e go give, nor go ever end.
25 E esta é a promessa que ele nos fez: a vida eterna.
26 Na dis tins I dey rite give una about pipol wey dey try to deceive una.
26 Estas coisas vos escrevo a respeito daqueles que vos querem enganar.
27 As for una, di Holy Spirit wey Christ give una, dey stay inside una, so una nor nid anybody to tish una again. Evritin wey di Holy Spirit dey tish, na true and lie nor dey inside. Just as e don tish una, make una stay inside am.
27 E quanto a vós, a unção que dele recebestes fica em vós, e não tendes necessidade de que alguém vos ensine; mas, como a sua unção vos ensina a respeito de todas as coisas, e é verdadeira, e não é mentira, como vos ensinou ela, assim nele permanecei.
28 Naw my shidren, make una stay inside am, so dat wen E kom, awa heart go dey strong well-well and shame nor go make us run from where E dey.
28 E agora, filhinhos, permanecei nele; para que, quando ele se manifestar, tenhamos confiança, e não fiquemos confundidos diante dele na sua vinda.
29 If una know sey E dey raitious, den una go know sey, doz wey dey do wetin God wont, na en shidren dem bi.
29 Se sabeis que ele é justo, sabeis que todo aquele que pratica a justiça é nascido dele.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 João 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.