1 Crônicas 19
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Leta, King Nahash for Ammon die and en pikin Hanun kon take-ova from am.
1 Depois disto, morreu Naás, rei dos filhos de Amom; e seu filho reinou em seu lugar.
2 King David sey, “I must go pay respet and make friend with King Hanun, just as King Nahash wey bi en papa, do give mi.” So David send messenjas go tell am sorry for en papa wey die.
2 Então, disse Davi: Usarei de bondade para com Hanum, filho de Naás, porque seu pai usou de bondade para comigo. Pelo que Davi enviou mensageiros para o consolar acerca de seu pai; e vieram os servos de Davi à terra dos filhos de Amom, a Hanum, para o consolarem.
3 doz wey bi leaders for Ammon kon tell di king, “Yu tink sey na, bikos of yor papa wey die naim make David send dis pipol kon tell yu sorry? Wi know sey e send dem kom look di land, so dat leta, e go kom fight and win us!”
3 Disseram os príncipes dos filhos de Amom a Hanum: Pensas que, por te haver Davi mandado consoladores, está honrando a teu pai? Não vieram seus servos a ti para reconhecerem, destruírem e espiarem a terra?
4 So King Hanun hold David messenjas, kut dia bear-bear and di klot for dia yansh side kon send dem go back.
4 Tomou, então, Hanum os servos de Davi, e rapou-os, e lhes cortou metade das vestes até às nádegas, e os despediu.
5 Shame nor let dem go house back. Wen King David hear wetin happen, e send message go meet dem sey make dem stay Jeriko until dia hair grow again.
5 Foram-se alguns e avisaram a Davi acerca destes homens; então, enviou mensageiros a encontrá-los, porque estavam sobremaneira envergonhados. Mandou o rei dizer-lhes: Deixai-vos estar em Jericó, até que vos torne a crescer a barba; e, então, vinde.
6 Wen King Hanun and Ammon pipol know sey dem don make David dia enemy, dem kon use about 75,000 pound for silva take go hire men from Aram Naharaim, Aram Maaka and Zobah.
6 Vendo, pois, os filhos de Amom que se haviam tornado odiosos a Davi, então, Hanum e os filhos de Amom tomaram mil talentos de prata, para alugarem para si carros e cavaleiros da Mesopotâmia, e dos siros de Maaca, e de Zoba.
7 Di 32,000 shariot wey dem hire and Maaka sojas kon kamp near Medeba. All Ammon pipol ready kom from dia town to fight.
7 Alugaram para si trinta e dois mil carros, o rei de Maaca e a sua gente, e eles vieram e se acamparam diante de Medeba; também os filhos de Amom se ajuntaram das suas cidades e vieram para a guerra.
8 Wen David hear wetin happen, e kon send Joab with all en sojas go.
8 O que ouvindo Davi, enviou contra eles a Joabe com todo o exército dos valentes.
9 Ammon pipol mash go pozishon for di side wey dem take dey enter Rabbah wey bi dia kapital town and all di kings wey kom help dem, dey for di open field.
9 Saíram os filhos de Amom e ordenaram a batalha à entrada da porta da cidade; porém os reis que vieram estavam à parte, no campo.
10 Joab si sey dia enemy sojas go attack dem from both front and back, so e choose di strong-strong sojas for Israel kon make dem face Aramean pipol.
10 Vendo, pois, Joabe que estava preparada contra ele a batalha, tanto pela frente como pela retaguarda, escolheu dentre todos o que havia de melhor em Israel e os formou em linha contra os siros;
11 E kon sey make en broda, Abishai, dey kommand di oda sojas and dem kon face Ammon pipol.
11 e o resto do povo entregou a Abisai, seu irmão, e puseram-se em linha contra os filhos de Amom.
12 Joab tell Abishai, “If yu si sey Aramean pipol dey opress mi, make yu kom help mi and if Ammon pipol dey opress yu, I go kom help yu.
12 Disse Joabe: Se os siros forem mais fortes do que eu, tu me virás em socorro; e, se os filhos de Amom forem mais fortes do que tu, eu irei ao teu socorro.
13 Make yor heart dey strong! Make wi fight for awa pipol and God town and make God do wetin dey en mind.”
13 Sê forte, pois; pelejemos varonilmente pelo nosso povo e pelas cidades de nosso Deus; e faça o Senhor o que bem lhe parecer.
14 Wen Joab with en pipol attack, Aramean pipol kon bigin run.
14 Então, avançou Joabe com o povo que estava com ele, e travaram peleja contra os siros; e estes fugiram de diante dele.
15 Wen Ammon pipol si Aramean pipol dey run, dem too kon start to run from Abishai go inside dia town. Den Joab and en sojas kon go back to Jerusalem.
15 Vendo os filhos de Amom que os siros fugiam, também eles fugiram de diante de Abisai, irmão de Joabe, e entraram na cidade; voltou Joabe dos filhos de Amom e tornou a Jerusalém.
16 Wen Aramean pipol si sey Israel pipol don win dem, dem kon send for more men from di east side for Eufrates river and na Shobak wey dey kommand Hadadeza soja for Zobah, bi dia kommander.
16 Vendo, pois, os siros que tinham sido desbaratados diante de Israel, enviaram mensageiros e fizeram sair os siros que habitavam do lado dalém do rio; Sofaque, capitão do exército de Hadadezer, marchava adiante deles.
17 Wen David hear am, e gada Israel sojas, cross Jordan River kon face Aramean pipol and dem kon start to fight.
17 Informado Davi, ajuntou a todo o Israel, passou o Jordão, veio ter com eles e ordenou contra eles a batalha; e, tendo Davi ordenado a batalha contra os siros, pelejaram estes contra ele.
18 Israel pipol kon porshu Aramean sojas go back. David with en men kill 7,000 shariot drivers and 40,000 sojas wey dey waka with leg. Dem still kill Shobak wey bi Aramean sojas kommander.
18 Porém os siros fugiram de diante de Israel, e Davi matou dentre os siros os homens de sete mil carros e quarenta mil homens de pé; a Sofaque, chefe do exército, matou.
19 Wen di kings wey dey respet King Hadadeza si sey Israel pipol don win dem well-well, dem kon go make peace and bigin obey King David.
19 Vendo, pois, os servos de Hadadezer que foram feridos diante de Israel, fizeram paz com Davi e o serviram; e os siros nunca mais quiseram socorrer aos filhos de Amom.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Crônicas 19, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.