1 Coríntios 9
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 I nor dey free? I nor bi apostle? Abi I neva si awa Oga God Jesus? Nor bi una dey show di work wey I don do?
1 Não sou livre? Não sou apóstolo? Não vi Jesus, nosso Senhor? Não são vocês resultado do meu trabalho no Senhor?
2 If I nor bi apostle to oda pipol, at least I bi apostle to una, bikos na una bi di sign wey show sey I bi Jesus Christ apostle.
2 Ainda que eu não seja apóstolo para outros, certamente o sou para vocês! Pois vocês são o selo do meu apostolado no Senhor.
3 Wen pipol ask mi kweshon, I dey tell dem sey,
3 Esta é minha defesa diante daqueles que me julgam.
4 mi and Banabas fit chop and drink wetin wi like,
4 Não temos nós o direito de comer e beber?
5 abi wi nor get rite to marry biliver for Christ?
5 Não temos nós o direito de levar conosco uma esposa crente como fazem os outros apóstolos, os irmãos do Senhor e Pedro?
6 Na only wi must work before wi go chop?
6 Ou será que apenas eu e Barnabé não temos o direito de deixar de trabalhar para termos sustento?
7 E get any soja wey dey pay ensef salari? Abi who plant vegitabol, nor dey chop for inside? Or who dey keep sheep nor dey drink from dia milk?
7 Quem serve como soldado às suas próprias custas? Quem planta uma vinha e não come do seu fruto? Quem apascenta um rebanho e não bebe do seu leite?
8 Una tink sey na only kommon sense I take dey tok all dis tins? Abi una don forget sey di law tok like dis too?
8 Não digo isso do ponto de vista meramente humano; a Lei não diz a mesma coisa?
9 Moses sey, “Make una allow animal wey grind korn chop from wetin e dey grind.” So, una tink sey na di melu God dey worry for?
9 Pois está escrito na Lei de Moisés: "Não amordace o boi enquanto ele estiver debulhando o cereal". Por acaso é com bois que Deus está preocupado?
10 No! Na wi God dey tok about. Dem rite all dis tins for di law, so dat evribody wey work, go fit chop for harvest time.
10 Não é certamente por nossa causa que ele o diz? Sim, isso foi escrito em nosso favor. Porque "o lavrador quando ara e o debulhador quando debulha, devem fazê-lo na esperança de participar da colheita".
11 So if wi don plant spiritual seed among una, e go dey too mush if wi ask for ordinary food and drink from una?
11 Se entre vocês semeamos coisas espirituais, seria demais colhermos de vocês coisas materiais?
12 If odas dey do like dis, dat mean sey wi even get betta rite to do like dat too. But, wi dey bear evritin, so dat wi nor go kause trobol for Christ message.
12 Se outros têm direito de ser sustentados por vocês, não o temos nós ainda mais? Mas nós nunca usamos desse direito. Pelo contrário, suportamos tudo para não colocar obstáculo algum ao evangelho de Cristo.
13 Una nor know sey doz wey dey work for di temple dey chop food wey pipol bring kon give God for der? Abi una nor know sey pesin wey dey serve for altar na from der e for dey chop?
13 Vocês não sabem que aqueles que trabalham no templo alimentam-se das coisas do templo, e que os que servem diante do altar participam do que é oferecido no altar?
14 Na so too God kommand sey, doz wey dey prish di gospel, go chop thru di gospel wey dem dey prish.
14 Da mesma forma o Senhor ordenou àqueles que pregam o evangelho, que vivam do evangelho.
15 But I nor dey use all dis rite and I nor dey rite dis tins so dat pesin go give mi sometin. E betta make I die, dan make anybody kon make mi stop to dey tok like dis.
15 Mas eu não tenho usado de nenhum desses direitos. Não estou escrevendo na esperança de que vocês façam isso por mim. Prefiro morrer a permitir que alguém me prive deste meu orgulho.
16 Bikos if I dey prish di gospel, I nor get any rizin to boast, bikos I nor fit do any oda tin dan to dey prish di gospel! Na wahala for mi, if I nor prish di gospel!
16 Contudo, quando prego o evangelho, não posso me orgulhar, pois me é imposta a necessidade de pregar. Ai de mim se não pregar o evangelho!
17 If I prish bikos I wont prish, dem go pay mi, but even if I nor wont prish, di prishin na wetin God send mi kom do.
17 Porque, se prego de livre vontade, tenho recompensa; contudo, como prego por obrigação, estou simplesmente cumprindo uma incumbência a mim confiada.
18 Wetin kon bi my gain? Na to prish di gospel without pay or na to use di rite wey I get, bikos I dey prish di gospel?
18 Qual é, pois, a minha recompensa? Apenas esta: que, pregando o evangelho, eu o apresente gratuitamente, não usando, assim, dos meus direitos ao pregá-lo.
19 I nor bi anybody savant. But I don turn savant to evribody, so dat I go fit win many pipol for Christ.
19 Porque, embora seja livre de todos, fiz-me escravo de todos, para ganhar o maior número possível de pessoas.
20 Wen I dey with Jew pipol, I dey live like dem, so dat I go win dem for Christ. Na Moses Law dem dey follow, but I nor dey follow dat one. But I dey live as di law tok, so dat I go win souls kom meet Christ.
20 Tornei-me judeu para os judeus, a fim de ganhar os judeus. Para os que estão debaixo da lei, tornei-me como se estivesse sujeito à lei, ( embora eu mesmo não esteja debaixo da lei ), a fim de ganhar os que estão debaixo da lei.
21 And wen I dey with pipol wey nor dey live by di law, I nor dey use di law for dem, so dat I go fit win dem. But dat nor mean sey, I go forget God law, bikos na Christ law dey rule mi.
21 Para os que estão sem lei, tornei-me como sem lei ( embora não esteja livre da lei de Deus, mas sim sob a lei de Cristo ), a fim de ganhar os que não têm a lei.
22 Wen I dey with pipol wey get weak faith, I dey live as dem dey live, so dat I go fit win dem. I dey do evritin wey I fit do, so dat I go fit win evribody wey I fit win, kom meet Christ.
22 Para com os fracos tornei-me fraco, para ganhar os fracos. Tornei-me tudo para com todos, para de alguma forma salvar alguns.
23 Na di gospel make mi dey do all dis tins, so dat I go fit share for di blessings.
23 Faço tudo isso por causa do evangelho, para ser co-participante dele.
24 Una nor know sey, wen pipol dey run, na only one pesin go win di race and di prize? So make una run, so dat una go fit win!
24 Vocês não sabem que dentre todos os que correm no estádio, apenas um ganha o prêmio? Corram de tal modo que alcancem o prêmio.
25 Pipol wey dey run, dey train well-well, so dat dem go win crown wey nor dey last, but wi dey run for crown wey go last forever.
25 Todos os que competem nos jogos se submetem a um treinamento rigoroso, para obter uma coroa que logo perece; mas nós o fazemos para ganhar uma coroa que dura para sempre.
26 So I nor dey run for nor-tin and I nor dey follow breeze fight.
26 Sendo assim, não corro como quem corre sem alvo, e não luto como quem esmurra o ar.
27 Instead, I dey kontrol my body kon make am my slave, so dat afta I don prish di Good News give odas, God nor go rijet mi.
27 Mas esmurro o meu corpo e faço dele meu escravo, para que, depois de ter pregado aos outros, eu mesmo não venha a ser reprovado.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Coríntios 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.