1 Coríntios 7

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Naw I go ansa di kweshon wey una ask for una leta. Una ask sey, “E dey good make pesin nor marry?”
1 Ora, quanto às coisas que me escrevestes, bom seria que o homem não tocasse em mulher;
2 But make una nor for dey do ashawo, e betta make una marry.
2 mas, por causa da prostituição, cada um tenha a sua própria mulher, e cada uma tenha o seu próprio marido.
3 Make husband and wife do di rite tin wey dem suppose do for one anoda.
3 O marido pague à mulher a devida benevolência, e da mesma sorte a mulher, ao marido.
4 Nor bi di wife get en own body, but na di husband get am and na so too di wife get en husband body.
4 A mulher não tem poder sobre o seu próprio corpo, mas tem-no o marido; e também, da mesma maneira, o marido não tem poder sobre o seu próprio corpo, mas tem-no a mulher.
5 Make una nor refuse each oda, escept una gri sey una go dey like dat for sometaim, so dat una go fit pray. Den Satan nor go fit tempt una, bikos una go fit kontrol una body.
5 Não vos defraudeis um ao outro, senão por consentimento mútuo, por algum tempo, para vos aplicardes à oração; e, depois, ajuntai-vos outra vez, para que Satanás vos não tente pela vossa incontinência.
6 Na advise I dey give una, nor bi kommand.
6 Digo, porém, isso como que por permissão e não por mandamento.
7 How I wish sey all of una bi like mi. But di gift wey God give us nor bi di same.
7 Porque quereria que todos os homens fossem como eu mesmo; mas cada um tem de Deus o seu próprio dom, um de uma maneira, e outro de outra.
8 Dis na di advise wey I go tell di pesin wey neva marry and doz wey dia husband or wife don die; make una dey as una dey, just as I bi.
8 Digo, porém, aos solteiros e às viúvas, que lhes é bom se ficarem como eu.
9 But if dem nor fit kontrol demsef, make dem marry, bikos e betta make pesin marry, dan make e dey tink bad tin for en mind.
9 Mas, se não podem conter-se, casem-se. Porque é melhor casar do que abrasar-se.
10 Na doz wey don marry I won give dis kommand to (Nor bi mi, but na God): Make wife nor leave en husband,
10 Todavia, aos casados, mando, não eu, mas o Senhor, que a mulher se não aparte do marido.
11 but if e leave am, make e nor marry again or make e go back go setol with di man. And make husband nor leave en wife too.
11 Se, porém, se apartar, que fique sem casar ou que se reconcilie com o marido; e que o marido não deixe a mulher.
12 Even doh I dey tok on my own, I nor tink sey God go tok anytin difren from wetin I dey tell una about marriage. Di only tin wey I fit do na to give una my advise. If yor wife nor dey follow Christ, but e sey e go follow yu stay, make yu nor drive am.
12 Mas, aos outros, digo eu, não o Senhor: se algum irmão tem mulher descrente, e ela consente em habitar com ele, não a deixe.
13 If yor husband nor dey follow Christ, but e sey e go follow yu stay, make yu nor run leave am.
13 E se alguma mulher tem marido descrente, e ele consente em habitar com ela, não o deixe.
14 Bikos di husband wey nor bilive, God go save am, bikos of en wife wey bilive and di wife wey nor bilive, God go save am, bikos of en husband wey bilive.
14 Porque o marido descrente é santificado pela mulher, e a mulher descrente é santificada pelo marido. Doutra sorte, os vossos filhos seriam imundos; mas, agora, são santos.
15 But if di one wey nor bilive komot from di marriage, make e bi like dat. For dis kind kase, di broda or sista wey bilive, don dey free; bikos God wont make wi enjoy peace.
15 Mas, se o descrente se apartar, aparte-se; porque neste caso o irmão, ou irmã, não está sujeito à servidão; mas Deus chamou-nos para a paz.
16 Yu wife! How yu take know sey yu nor go fit save yor husband? Yu husband! How yu take know sey yu nor go fit save yor wife?
16 Porque, donde sabes, ó mulher, se salvarás teu marido? Ou, donde sabes, ó marido, se salvarás tua mulher?
17 For evry church, I dey tell di pipol sey make dem remain as dem bi wen Oga God Jesus choose and koll dem to bi en own. Naw, na di same tin I dey tell una so.
17 E, assim, cada um ande como Deus lhe repartiu, cada um, como o Senhor o chamou. É o que ordeno em todas as igrejas.
18 If yu don already sekonsaiz, make yu dey like dat. If dem neva sekonsaiz yu, make yu nor sekonsaiz.
18 É alguém chamado, estando circuncidado? Fique circuncidado. É alguém chamado, estando incircuncidado? Não se circuncide.
19 Weda dem sekonsaiz yu or not, nor mean anytin. Wetin dey important, na to obey God law.
19 A circuncisão é nada, e a incircuncisão nada é, mas, sim, a observância dos mandamentos de Deus.
20 So make una nor try to shange as una bi wen God choose una.
20 Cada um fique na vocação em que foi chamado.
21 If God koll yu wen yu bi slave, make yu nor let am worry yu. But if yu fit get yor freedom, make yu get am.
21 Foste chamado sendo servo? Não te dê cuidado; e, se ainda podes ser livre, aproveita a ocasião.
22 Slave wey God choose make e follow Jesus, don bikom free man thru Jesus Christ. So free man wey God choose make e follow Jesus, don turn to Christ savant.
22 Porque o que é chamado pelo Senhor, sendo servo, é liberto do Senhor; e, da mesma maneira, também o que é chamado, sendo livre, servo é de Cristo.
23 God pay big prize for una, so make una nor bi slave to any oda pesin.
23 Fostes comprados por bom preço; não vos façais servos dos homens.
24 Make una stay as una bi wen God choose and koll una.
24 Irmãos, cada um fique diante de Deus no estado em que foi chamado.
25 Koncerning pipol wey neva marry before, I nor get any kommand from Christ to give una, but I go advise una as pesin wey una fit trust, bikos God dey show mi mesi.
25 Ora, quanto às virgens, não tenho mandamento do Senhor; dou, porém, o meu parecer, como quem tem alcançado misericórdia do Senhor para ser fiel.
26 Dis time wey wi dey nor eazy at-all and wetin I tink bi sey, e go good make una stay as una bi naw.
26 Tenho, pois, por bom, por causa da instante necessidade, que é bom para o homem o estar assim.
27 If yu don marry, nor leave yor marriage. If yu neva marry, make yu nor worry yorsef about am.
27 Estás ligado à mulher? Não busques separar-te. Estás livre de mulher? Não busques mulher.
28 If pesin wey neva marry before kon marry, e nor sin. But, pipol wey don marry go face plenty wahala and I dey try to help una, so dat una nor go face dat kind wahala.
28 Mas, se te casares, não pecas; e, se a virgem se casar, não peca. Todavia, os tais terão tribulações na carne, e eu quereria poupar-vos.
29 My friends, wetin I mean bi sey Christ go soon kom and e nor matter if yu don marry or not.
29 Isto, porém, vos digo, irmãos: que o tempo se abrevia; o que resta é que também os que têm mulheres sejam como se as não tivessem;
30 If yu dey kry or laf; dey buy sometin or yu nor get money, all na di same tin.
30 e os que choram, como se não chorassem; e os que folgam, como se não folgassem; e os que compram, como se não possuíssem;
31 E nor go make any difrence even if yu get all di tins for dis world or sey yu like di world well-well, bikos as wi know, di world go soon vanish komot.
31 e os que usam deste mundo, como se dele não abusassem, porque a aparência deste mundo passa.
32 And I nor wont make anytin trobol una. Man wey neva marry, make e dey do tins wey go make Christ happy for am.
32 E bem quisera eu que estivésseis sem cuidado. O solteiro cuida das coisas do Senhor, em como há de agradar ao Senhor;
33 But man wey don marry get plenty tins to worry about. E go must worry about tins for dis world, bikos e go wont make belle dey sweet en wife,
33 mas o que é casado cuida das coisas do mundo, em como há de agradar à mulher.
34 so e go dey tink about difren tins. Woman wey neva marry dey only tink of how to make belle sweet Christ. Dat time, dia body and mind dey pure. But woman wey don marry dey worry about dis world tins, bikos e wont make belle sweet en husband.
34 Há diferença entre a mulher casada e a virgem: a solteira cuida das coisas do Senhor para ser santa, tanto no corpo como no espírito; porém a casada cuida das coisas do mundo, em como há de agradar ao marido.
35 Wetin I dey tok na for una own good, nor bi to make una slave. I wont help una to dey live betta life and to love Christ pass any oda tin.
35 E digo isso para proveito vosso; não para vos enlaçar, mas para o que é decente e conveniente, para vos unirdes ao Senhor, sem distração alguma.
36 But if yu get patina and yu nor fit kontrol yorsef, den make yu go marry. Nor-tin dey bad for dat one.
36 Mas, se alguém julga que trata dignamente a sua virgem, se tiver passado a flor da idade, e se for necessário, que faça o tal o que quiser; não peca; casem-se.
37 But e betta, if yu fit kontrol yor body sey yu nor won marry naw.
37 Todavia, o que está firme em seu coração, não tendo necessidade, mas com poder sobre a sua própria vontade, se resolveu no seu coração guardar a sua virgem, faz bem.
38 E dey rite and okay to marry, but e betta sey yu nor marry at-all.
38 De sorte que, o que a dá em casamento faz bem; mas o que a não dá em casamento faz melhor.
39 Wife suppose to stay with en husband until di man die. Den e fit go marry again, but di new husband must bi pesin wey dey follow Christ.
39 A mulher casada está ligada pela lei todo o tempo em que o seu marido vive; mas, se falecer o seu marido, fica livre para casar com quem quiser, contanto que seja no Senhor.
40 But I bilive sey, I dey obey God Spirit wen I sey make di woman nor marry, so dat e go dey happy well-well.
40 Será, porém, mais bem-aventurada se ficar assim, segundo o meu parecer, e também eu cuido que tenho o Espírito de Deus.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Coríntios 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.