1 Coríntios 6

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Wen pesin nor dey gri with anoda pesin, una dey take una kase go kourt where sinnas go judge di matter, abi una dey take am go meet God pipol?
1 Aventura-se algum de vós, tendo questão contra outro, a submetê-lo a juízo perante os injustos e não perante os santos?
2 Una nor know sey na God pipol go judge di world? And if na una go judge di world, una nor fit setol small-small matter among unasef?
2 Ou não sabeis que os santos hão de julgar o mundo? Ora, se o mundo deverá ser julgado por vós, sois, acaso, indignos de julgar as coisas mínimas?
3 Una nor know sey wi go judge angels? Since na so, den wi suppose to judge di tins wey dey dis world!
3 Não sabeis que havemos de julgar os próprios anjos? Quanto mais as coisas desta vida!
4 So, na wetin make us dey take awa kase go give judge wey nor know God?
4 Entretanto, vós, quando tendes a julgar negócios terrenos, constituís um tribunal daqueles que não têm nenhuma aceitação na igreja.
5 I dey tok like dis, so dat una go shame! So una nor get wise pesin among una wey fit judge between una wey bi Christians?
5 Para vergonha vo-lo digo. Não há, porventura, nem ao menos um sábio entre vós, que possa julgar no meio da irmandade?
6 Wetin dey make una karry unasef go meet judge wey nor know God?
6 Mas irá um irmão a juízo contra outro irmão, e isto perante incrédulos!
7 Wen una take unasef go kourt, dat mean sey all of una don luz.
7 O só existir entre vós demandas já é completa derrota para vós outros. Por que não sofreis, antes, a injustiça? Por que não sofreis, antes, o dano?
8 Instead, una dey play wayo among unasef!
8 Mas vós mesmos fazeis a injustiça e fazeis o dano, e isto aos próprios irmãos!
9 Una nor know sey wiked pipol nor go enter God kingdom? So make una nor fool unasef! Pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey serve juju; men wey dey sleep with oda men;
9 Ou não sabeis que os injustos não herdarão o reino de Deus? Não vos enganeis: nem impuros, nem idólatras, nem adúlteros, nem efeminados, nem sodomitas,
10 tif; long-trot; drunkard; doz wey dey curse pipol and doz wey dey play wayo; non of dem go enter God kingdom.
10 nem ladrões, nem avarentos, nem bêbados, nem maldizentes, nem roubadores herdarão o reino de Deus.
11 Na so some among una bi before, but naw, God don wosh una klean thru Jesus Christ name and en Spirit pawa, don make una klean for en eye.
11 Tais fostes alguns de vós; mas vós vos lavastes, mas fostes santificados, mas fostes justificados em o nome do Senhor Jesus Cristo e no Espírito do nosso Deus.
12 Some among una sey, “Wi fit do anytin wey wi wont.” But I dey tell una naw sey, nor bi evritin dey good for us. So I nor go gri make anytin kontrol mi.
12 Todas as coisas me são lícitas, mas nem todas convêm. Todas as coisas me são lícitas, mas eu não me deixarei dominar por nenhuma delas.
13 Una still dey sey, “Food dey good for awa body and awa body nid food.” But I dey tell una, “God go distroy di two of dem.” So make wi nor use awa body take do yeye tins.
13 Os alimentos são para o estômago, e o estômago, para os alimentos; mas Deus destruirá tanto estes como aquele. Porém o corpo não é para a impureza, mas, para o Senhor, e o Senhor, para o corpo.
14 God go raiz us from deat with di same pawa wey E use take raiz Jesus.
14 Deus ressuscitou o Senhor e também nos ressuscitará a nós pelo seu poder.
15 Una nor know sey una body na part for Christ body? So e dey good make wi put awa body for ashawo work? God forbid!
15 Não sabeis que os vossos corpos são membros de Cristo? E eu, porventura, tomaria os membros de Cristo e os faria membros de meretriz? Absolutamente, não.
16 Una nor know sey, pesin wey dey sleep anyhow with oda pipol, don bi part for di pipol body?
16 Ou não sabeis que o homem que se une à prostituta forma um só corpo com ela? Porque, como se diz, serão os dois uma só carne.
17 So anybody wey join Christ, don get one spirit with am.
17 Mas aquele que se une ao Senhor é um espírito com ele.
18 Make una nor live ashawo life. Evry oda sin wey man dey kommit na for outside en body, but di pesin wey dey do ashawo, dey sin against en own body.
18 Fugi da impureza. Qualquer outro pecado que uma pessoa cometer é fora do corpo; mas aquele que pratica a imoralidade peca contra o próprio corpo.
19 Abi una nor know sey una body na di temple wey di Holy Spirit dey stay? So, nor bi una get unasef.
19 Acaso, não sabeis que o vosso corpo é santuário do Espírito Santo, que está em vós, o qual tendes da parte de Deus, e que não sois de vós mesmos?
20 God don pay betta prize for una, so make una honor am with una body.
20 Porque fostes comprados por preço. Agora, pois, glorificai a Deus no vosso corpo.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Coríntios 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.