1 Coríntios 5

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ

Sair da comparação
1 I don dey hear bad-bad tins about some of una. And una own even worse pass wetin doz wey nor know God dey do. Sotey man dey sleep with en papa wife.
1 É relatado frequentemente que há fornicação entre vós, e fornicação tal, que nem ainda entre os gentios é mencionado, que alguém possua a mulher de seu pai.
2 And shame nor even dey katch una! Una suppose to feel bad kon drive di pesin wey do dis kind tin.
2 E vós estais convencidos, e nem vos haveis entristecido para que fosse tirado do meio de vós o que fez esta ação.
3 I know sey I nor dey der with una naw, but I dey with una for spirit. And I don already judge di pesin, just as I go do if I dey der.
3 Pois eu, na verdade, ainda que ausente no corpo, mas presente no espírito, já julguei, como se eu estivesse presente, a respeito daquele que fez tal ato,
4 Wen una gada togeda for awa Oga God Jesus Christ name, I dey with una for spirit and Christ pawa dey with una too.
4 em nome de nosso Senhor Jesus Cristo, reunidos vós e o meu espírito, com o poder de nosso Senhor Jesus Cristo,
5 So make una give dat pesin to Satan make e ponish am, so dat en sin go komot for en body and Christ go save am for di last day.
5 o tal seja entregue a Satanás para destruição da carne, para que o espírito seja salvo no dia do Senhor Jesus.
6 E nor good make una dey boast! Una nor know sey, small yist wey dem put for bread, na-im dey make di whole bread raiz?
6 A vossa vanglória não é boa. Não sabeis que um pouco de fermento leveda a massa toda?
7 Make una remove di old yist, den una go bi like fresh bread wey nor get yist and dat na wetin una bi. Bikos awa Passova lamb, na Christ wey dem don already sakrifice.
7 Purificai-vos, pois, do fermento velho, para que sejais uma nova massa, assim como estais sem fermento. Porque Cristo, nossa Páscoa, foi sacrificado por nós;
8 So wen wi dey celebrate Passova, make wi nor do am with di old yist wey bi wikedness and bad belle, but make wi do am with di fresh bread wey nor get yist, wey bi trut and betta mind.
8 portanto, celebremos a festa, não com o fermento velho, nem com o fermento da maldade e da malícia, mas com os pães não fermentados da sinceridade e da verdade.
9 For di leta wey I first rite give una, I sey make una nor make friend with bad pipol.
9 Eu vos tenho escrito por carta para não vos ajuntardes com os fornicadores;
10 But I nor dey tok about pipol wey bad, wiked, dey serve juju and get long-trot for dis world. If to sey na dem I dey tok about, den una nid to komot for dis world.
10 porém não quis dizer com os fornicadores deste mundo, ou com os avarentos, ou com os extorquidores, ou com os idólatras; porque então vos seria necessário sair do mundo.
11 But naw, I dey rite to una sey, pipol wey sey dem bi Christians and dem dey do bad tins, make una nor follow dem make friend. Make una nor even chop with dat kind pesin.
11 Mas, agora, escrevi que não vos mantenhais na companhia de qualquer homem que chamado de irmão seja um fornicador, ou avarento, ou idólatra, ou caluniador, ou beberrão, ou extorquidor; com o tal nem ainda comais.
12 Wetin go make mi judge pipol wey nor dey di church? Nor bi doz wey dey inside wi suppose to judge?
12 Porque, que tenho eu em julgar também os que estão de fora? Não fazeis julgamento vós os que estão dentro?
13 Na God go judge doz wey dey outside, bikos en word sey, “Doz wey dey do wiked tins among una, make una drive dem komot from di church.”
13 Mas Deus julga os que estão de fora. Portanto, apartai dentre vós, essa pessoa perversa.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Coríntios 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.