1 Coríntios 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Make una dey tink about us as Christ savant wey God don show en sekret.
1 Assim, pois, importa que todos nos considerem como ministros de Cristo e encarregados dos mistérios de Deus.
2 God wont make wi dey faithful to am.
2 Ora, além disso, o que se requer destes encarregados é que cada um deles seja encontrado fiel.
3 So, e nor koncern mi if yu or any human kourt dey judge mi. Even mi nor fit judge mysef.
3 Mas a mim pouco importa ser julgado por vocês ou por um tribunal humano; nem eu julgo a mim mesmo.
4 My mind dey klear, but dat nor mean sey I dey innocent. Na only God go fit judge mi.
4 Porque a consciência não me acusa de nada. Mas nem por isso me dou por justificado, pois quem me julga é o Senhor.
5 So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.
5 Portanto, não julguem nada antes do tempo, até que venha o Senhor, o qual não somente trará à plena luz as coisas ocultas das trevas, mas também manifestará os desígnios dos corações. E então cada um receberá o seu louvor da parte de Deus.
6 My friends, I don use mysef and Apollos as ezample for una, so dat thru us, una go know wetin e mean to obey di law. I nor wont make una dey sey one of us betta pass di oda pesin.
6 Meus irmãos, apliquei estas coisas figuradamente a mim mesmo e a Apolo, por causa de vocês, para que por nosso exemplo vocês aprendam isto: “Não ultrapassem o que está escrito”, para que ninguém se encha de orgulho a favor de um em prejuízo de outro.
7 Wetin make una tink sey, una betta pass anoda pesin? Nor bi God give una evritin? So wetin make una dey boast wen e bi sey evritin wey una get, na God give una?
7 Pois quem é que faz com que você sobressaia? E o que é que você tem que não tenha recebido? E, se o recebeu, por que se gloria, como se não o tivesse recebido?
8 Una don really get evritin wey una nid! Una don get plenty money! Una don turn king with us! How I wish sey una really bi king, so dat wi go dey rule with una.
8 Vocês já estão fartos! Já são ricos! Chegaram a reinar sem nós! Sim, quem dera que vocês fossem reis, para que também nós viéssemos a reinar com vocês!
9 Bikos e klear sey, di place wey God give us wey bi en apostles, na where worse pass for di world; wi bi like prisonas wey dem dey go kill. Angels and dis world pipol just dey take us make yeye.
9 Porque me parece que Deus pôs a nós, os apóstolos, em último lugar, como se fôssemos condenados à morte. Porque nos tornamos espetáculo para o mundo, tanto para os anjos como para os seres humanos.
10 Bikos of Christ, pipol dey si us as fools, but God don make us wise. Wi weak and dem hate us, but dem dey respet una wey dey strong.
10 Nós somos loucos por causa de Cristo, e vocês são sábios em Cristo. Nós somos fracos, e vocês são fortes; vocês são honrados, e nós somos desprezados.
11 Even today, wi dey hongry for food and wota, na only rag wi get to wear. Dem dey trit us anyhow and wi nor get house to stay.
11 Até a presente hora, sofremos fome, sede e nudez; somos esbofeteados e não temos morada certa;
12 Wi dey work hard before wi go fit chop and as pipol dey curse us, na blessing wi dey give dem back. Wen wi dey sofa, wi dey-dey patient.
12 e nos afadigamos, trabalhando com as nossas próprias mãos. Quando somos insultados, bendizemos; quando somos perseguidos, suportamos;
13 Wen pesin curse us, wi nor dey ansa back with kworel. So till today, dem dey si us as dirty for dis world.
13 quando somos caluniados, procuramos conciliação. Até agora, temos chegado a ser considerados lixo do mundo, escória de todos.
14 I nor dey rite dis tins make una for shame, but na to korrect una as shidren wey I love.
14 Não escrevo estas coisas para que vocês fiquem envergonhados; pelo contrário, para admoestá-los como a meus filhos amados.
15 Bikos even if 10,000 pipol kon tish una about Christ, na only one papa una go still get. Bikos una don turn to my pikin, wen una receive di message about Christ from mi.
15 Porque, ainda que vocês tivessem milhares de instrutores em Cristo, não teriam muitos pais, pois eu gerei vocês em Cristo Jesus, pelo evangelho.
16 So, I dey enkourage una sey, make una bi like mi.
16 Portanto, eu peço a vocês que sejam meus imitadores.
17 Na to enkourage una make mi send Timoti, my son wey I like and wey love Christ kom meet una. E go tell una how I dey follow Christ and di tins wey I dey prish about Christ for evry church.
17 Por esta causa, eu enviei até vocês Timóteo, que é meu filho amado e fiel no Senhor, o qual fará com que vocês se lembrem dos meus caminhos em Cristo Jesus, como, por toda parte, ensino em cada igreja.
18 Some among una don dey karry body up, bikos una tink sey I nor go kom back again.
18 Alguns de vocês se encheram de orgulho, como se eu não fosse mais visitá-los.
19 But if God allow mi, I go soon kom meet una. Den I go know if pipol wey dey boast, really get pawa.
19 Mas, em breve, se o Senhor quiser, irei visitá-los, e então conhecerei não a palavra, mas o poder desses orgulhosos.
20 Bikos God kingdom matter, nor bi about ordinary tok, but na about pawa.
20 Porque o Reino de Deus consiste não em palavra, mas em poder.
21 Wish one una wont? Make I karry kane kom meet una, or make I kon show una di love wey di Spirit dey give pesin?
21 O que vocês preferem? Que eu vá até aí com um chicote ou com amor e espírito de mansidão?

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Coríntios 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.