1 Coríntios 3
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 My brodas and sistas, wen I dey with una before, una dey bihave like pipol for dis world. Na dis make mi nor fit tok to una as pipol wey get God Spirit. Dat time, una faith for Christ bi like small pikin own.
1 E eu, irmãos não vos pude falar como a espirituais, mas como a carnais, como a criancinhas em Cristo.
2 So I dey feed una with milk like small pikin and as e bi naw, una neva still fit chop strong food,
2 Leite vos dei por alimento, e não comida sólida, porque não a podíeis suportar; nem ainda agora podeis;
3 bikos una neva get di Spirit since jealousy and kworel still dey among una. Dis mean sey una neva get di Spirit and una still dey live like pipol wey dey di world.
3 porquanto ainda sois carnais; pois, havendo entre vós inveja e contendas, não sois porventura carnais, e não estais andando segundo os homens?
4 Some of una dey sey, “Na Paul I dey follow,” odas sey, “Na Apollos bi awa leader.” Na pipol wey nor know God dey do like dat!
4 Porque, dizendo um: Eu sou de Paulo; e outro: Eu de Apolo; não sois apenas homens?
5 Mi and Apollos na God savant and E use us take prish to una make una for fit bilive, so mi and am dey do di work wey God sey make wi do.
5 Pois, que é Apolo, e que é Paulo, senão ministros pelos quais crestes, e isso conforme o que o Senhor concedeu a cada um?
6 I dey plant di seed and Apollos dey wota dem, but na God dey make di seed grow.
6 Eu plantei; Apolo regou; mas Deus deu o crescimento.
7 Pesin wey plant and di one wey wota, nor mean anytin, bikos na God dey make di seed grow.
7 De modo que, nem o que planta é alguma coisa, nem o que rega, mas Deus, que dá o crescimento.
8 Di pesin wey plant di seed and di one wey wota am, na di same work dem dey do, but each pesin go get en pay from God akordin to en work.
8 Ora, uma só coisa é o que planta e o que rega; e cada um receberá o seu galardão segundo o seu trabalho.
9 All of us na ko-workers for God and na una bi God farm and en buildings.
9 Porque nós somos cooperadores de Deus; vós sois lavoura de Deus e edifício de Deus.
10 Na God grace make mi sabi build well-well. I lay foundashon wey anoda pesin build put. But make wi take kare as wi dey build,
10 Segundo a graça de Deus que me foi dada, lancei eu como sábio construtor, o fundamento, e outro edifica sobre ele; mas veja cada um como edifica sobre ele.
11 bikos God don choose Jesus Christ as di One and only foundashon and dem nor go fit lay any oda foundashon.
11 Porque ninguém pode lançar outro fundamento, além do que já está posto, o qual é Jesus Cristo.
12 So if anybody use gold, silva, fine stones, wood, or difren grass take build on-top dis foundashon,
12 E, se alguém sobre este fundamento levanta um edifício de ouro, prata, pedras preciosas, madeira, feno, palha,
13 make e know sey, God go espose en work, bikos E go test am with fire for Judgement Day. Di fire go test di work wey evribody dey do.
13 a obra de cada um se manifestará; pois aquele dia a demonstrará, porque será revelada no fogo, e o fogo provará qual seja a obra de cada um.
14 God go reward us if di fire nor burn wetin wi build.
14 Se permanecer a obra que alguém sobre ele edificou, esse receberá galardão.
15 But if di fire distroy am, wi nor go get anytin. But wi go dey save like pesin wey dem drag komot from inside fire.
15 Se a obra de alguém se queimar, sofrerá ele prejuízo; mas o tal será salvo todavia como que pelo fogo.
16 Una nor know sey una bi God Temple and en Spirit dey inside una?
16 Não sabeis vós que sois santuário de Deus, e que o Espírito de Deus habita em vós?
17 So If anybody distroy God Temple, God go distroy dat pesin too, bikos God Temple dey holy and na una bi dat temple.
17 Se alguém destruir o santuário de Deus, Deus o destruirá; porque sagrado é o santuário de Deus, que sois vós.
18 Make una nor let anybody deceive una. If anybody tink sey e get sense for dis life, make e turn to fool, so dat e go really get sense.
18 Ninguém se engane a si mesmo; se alguém dentre vós se tem por sábio neste mundo, faça-se louco para se tornar sábio.
19 Dis world wisdom, na foolishness for God present. Bikos God word sey, “God dey ponish pipol wey tink sey dem wise.”
19 Porque a sabedoria deste mundo é loucura diante de Deus; pois está escrito: Ele apanha os sábios na sua própria astúcia;
20 God know sey na yeye tins wise pipol dey tink,
20 e outra vez: O Senhor conhece as cogitações dos sábios, que são vãs.
21 so, make wi stop to dey boast about wetin pesin do. Bikos both
21 Portanto ninguém se glorie nos homens; porque tudo é vosso;
22 Paul, Apollos, Pita, di world, life or deat; tins wey dey naw or tins wey go dey tumoro, all of dem na una own.
22 seja Paulo, ou Apolo, ou Cefas; seja o mundo, ou a vida, ou a morte; sejam as coisas presentes, ou as vindouras, tudo é vosso,
23 So una bi Christ own, just as Christ bi God own.
23 e vós de Cristo, e Cristo de Deus.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Coríntios 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.