1 Coríntios 2

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 My brodas and sistas, wen I kom tell una about God word, I nor tok to una with big-big word or try to show sey I get sense.
1 E eu, irmãos, quando fui ter convosco, anunciando-vos o testemunho de Deus, não fui com sublimidade de palavras ou de sabedoria.
2 Bikos wen I dey with una, I plan sey, Christ wey dem kill for cross, na only en message I go tok to una about.
2 Porque nada me propus saber entre vós, senão a Jesus Cristo, e este crucificado.
3 So wen I kom meet una, I dey weak and dey fear.
3 E eu estive convosco em fraqueza, e em temor, e em grande tremor.
4 Wen I dey tok and prish to una, I nor try to show sey I get sense, but I dey do evritin with God pawa wey di Holy Spirit dey give,
4 A minha linguagem e a minha pregação não consistiram em palavras persuasivas de sabedoria, mas em demonstração do Espírito de poder;
5 so dat una faith go dey for God pawa, nor bi human being wisdom.
5 para que a vossa fé não se apoiasse na sabedoria dos homens, mas no poder de Deus.
6 Wi dey tok with wisdom to doz wey really know God word, but nor bi with dis world or any ruler wisdom, bikos dia wisdom nor mean anytin.
6 Na verdade, entre os perfeitos falamos sabedoria, não porém a sabedoria deste mundo, nem dos príncipes deste mundo, que estão sendo reduzidos a nada;
7 Di tin wey I dey tok about, na God sekret wisdom wey E choose for us, even before E kreate di world.
7 mas falamos a sabedoria de Deus em mistério, que esteve oculta, a qual Deus preordenou antes dos séculos para nossa glória;
8 No ruler for dis world fit undastand God wisdom, bikos if to sey dem fit, dem for nor nail and kill Christ wey get glory.
8 a qual nenhum dos príncipes deste mundo compreendeu; porque se a tivessem compreendido, não teriam crucificado o Senhor da glória.
9 But God word sey, “No eye don ever si; no ear don hear, even pesin mind nor fit tink about di tins wey God don prepare for pipol wey love am.”
9 Mas, como está escrito: As coisas que olhos não viram, nem ouvidos ouviram, nem penetraram o coração do homem, são as que Deus preparou para os que o amam.
10 God show us dis tins thru en Spirit, bikos di Spirit dey find evritin; even di deep tins wey dey God mind.
10 Porque Deus no-las revelou pelo seu Espírito; pois o Espírito esquadrinha todas as coisas, mesmos as profundezas de Deus.
11 Na only pesin spirit know wetin dey di pesin mind and na only God Spirit know wetin dey God mind.
11 Pois, qual dos homens entende as coisas do homem, senão o espírito do homem que nele está? assim também as coisas de Deus, ninguém as compreendeu, senão o Espírito de Deus.
12 God give us en Spirit, so wi nor dey tink as dis world pipol dey tink and naim make us know di blessings wey God don give us.
12 Ora, nós não temos recebido o espírito do mundo, mas sim o Espírito que provém de Deus, a fim de compreendermos as coisas que nos foram dadas gratuitamente por Deus;
13 Evry word wey wi dey tok, na God Spirit tish us and nor bi human wisdom. Na dis same Spirit dey help us tish spiritual tins to pipol wey get God Spirit.
13 as quais também falamos, não com palavras ensinadas pela sabedoria humana, mas com palavras ensinadas pelo Espírito Santo, comparando coisas espirituais com espirituais.
14 So, na only who get God Spirit fit undastand spiritual blessings. Pesin wey nor get God Spirit, nor go fit undastand wetin di Spirit dey tok.
14 Ora, o homem natural não aceita as coisas do Espírito de Deus, porque para ele são loucura; e não pode entendê-las, porque elas se discernem espiritualmente.
15 Pesin wey dey listin to di Spirit fit judge oda pipol, but nobody go fit judge dem:
15 Mas o que é espiritual discerne bem tudo, enquanto ele por ninguém é discernido.
16 bikos God word sey, “Who fit know wetin God dey tink so dat e go advise am?” But wi wey get di Spirit, undastand wetin Christ dey tish.
16 Pois, quem jamais conheceu a mente do Senhor, para que possa instruí-lo? Mas nós temos a mente de Cristo.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Coríntios 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.