1 Coríntios 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Na Paul, wey God koll to bi Jesus Christ apostle and Sostenes, awa broda, na dem rite dis leta.
1 Paulo (chamado apóstolo de Jesus Cristo, pela vontade de Deus) e o irmão Sóstenes,
2 To God holy pipol for di church wey dey Korint, wey bi en own bikos of Jesus Christ and pipol for evriwhere wey dey woship awa Oga God Jesus Christ as dia Oga God and Savior.
2 à igreja de Deus que está em Corinto, aos santificados em Cristo Jesus, chamados santos, com todos os que em todo lugar invocam o nome de nosso Senhor Jesus Cristo, Senhor deles e nosso:
3 Make grace and peace wey God and Oga God Jesus Christ dey give, bi una own.
3 graça e paz, da parte de Deus, nosso Pai, e do Senhor Jesus Cristo.
4 I dey always tank God, bikos of di grace wey E give una thru Jesus Christ.
4 Sempre dou graças ao meu Deus por vós pela graça de Deus que vos foi dada em Jesus Cristo.
5 Bikos wi dey with Christ, God make us dey rish for evry side, both for wisdom and undastandin,
5 Porque em tudo fostes enriquecidos nele, em toda a palavra e em todo o conhecimento
6 bikos di message about Christ dey inside us,
6 (como foi mesmo o testemunho de Cristo confirmado entre vós).
7 so una nor go miss any gift wey di Holy Spirit dey give, as una dey wait for di day wen God go bring awa Oga God Jesus Christ kom back.
7 De maneira que nenhum dom vos falta, esperando a manifestação de nosso Senhor Jesus Cristo,
8 God go help una rish di end, so dat E nor go si fault for una life for di day wen Jesus go kom back.
8 o qual vos confirmará também até ao fim, para serdes irrepreensíveis no Dia de nosso Senhor Jesus Cristo.
9 God dey faithful, bikos na-im koll una to waka with en pikin, Jesus Christ wey bi awa Oga God.
9 Fiel é Deus, pelo qual fostes chamados para a comunhão de seu Filho Jesus Cristo, nosso Senhor.
10 My brodas and sistas, I dey beg una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor kworel, but make una get one mind for evritin wey una dey do.
10 Rogo-vos, porém, irmãos, pelo nome de nosso Senhor Jesus Cristo, que digais todos uma mesma coisa e que não haja entre vós dissensões; antes, sejais unidos, em um mesmo sentido e em um mesmo parecer.
11 Bikos I don hear thru Khloe family sey, una dey kworel among unasef.
11 Porque a respeito de vós, irmãos meus, me foi comunicado pelos da família de Cloe que há contendas entre vós.
12 Wetin I hear bi sey, some of una dey sey, “Na Paul side I dey” odas sey, “Na Apollos side I dey” some still sey, “Na Pita side I dey” or “Na Christ side I dey.”
12 Quero dizer, com isso, que cada um de vós diz: Eu sou de Paulo, e eu, de Apolo, e eu, de Cefas, e eu, de Cristo.
13 Una hear sey dem divide Christ? Na Paul dem hang kill for cross? Abi na Paul name dem take baptize una?
13 Está Cristo dividido? Foi Paulo crucificado por vós? Ou fostes vós batizados em nome de Paulo?
14 I tank God sey I nor baptize any of una escept Krispus and Gaius,
14 Dou graças a Deus, porque a nenhum de vós batizei, senão a Crispo e a Gaio;
15 so nobody go fit sey na my name dem take baptize am.
15 para que ninguém diga que fostes batizados em meu nome.
16 (I remember sey I still baptize Stefanas family. Apart from dem, I nor remember any oda pesin wey I baptize.)
16 E batizei também a família de Estéfanas; além destes, não sei se batizei algum outro.
17 Bikos Christ nor send mi go baptize, but na to prish di gospel and nor bi with ordinary wisdom wey go make di sofa wey Christ sofa for cross, yeye.
17 Porque Cristo enviou-me não para batizar, mas para evangelizar; não em sabedoria de palavras, para que a cruz de Cristo se não faça vã.
18 Di message about Christ deat for cross bi like foolish matter to pipol wey don lost, but for wi wey God don save, di message na God pawa.
18 Porque a palavra da cruz é loucura para os que perecem; mas para nós, que somos salvos, é o poder de Deus.
19 Bikos God word sey, “I go distroy di wisdom wey wise pipol feel sey dem get. I go konfuse doz wey tink sey dem know too mush.”
19 Porque está escrito: Destruirei a sabedoria dos sábios e aniquilarei a inteligência dos inteligentes.
20 Wetin happen to di wise pipol? Wetin happen to doz wey know Moses Law well-well? Wetin happen to doz wey tink sey dem get all di ansa? Abi God nor sey dis world wisdom, nor mean anytin?
20 Onde está o sábio? Onde está o escriba? Onde está o inquiridor deste século? Porventura, não tornou Deus louca a sabedoria deste mundo?
21 God wise well-well, so E nor let pipol for dis world know am with di wisdom wey dem get. Instead, E save only di pipol wey bilive di foolish message wey wi dey prish.
21 Visto como, na sabedoria de Deus, o mundo não conheceu a Deus pela sua sabedoria, aprouve a Deus salvar os crentes pela loucura da pregação.
22 Jew pipol won si mirakle before dem go bilive and Greek pipol, na wisdom dem won hear,
22 Porque os judeus pedem sinal, e os gregos buscam sabedoria;
23 but di true message about Jesus wey dem kill for cross, naim wi dey prish and di message bi like stone wey Jew pipol kick by mistake kon fall, but to Gentile pipol, na yeye tin e bi.
23 mas nós pregamos a Cristo crucificado, que é escândalo para os judeus e loucura para os gregos.
24 But for wi wey God don koll, weda wi bi Jew or Greek; na Christ bi God pawa and wisdom wey save us.
24 Mas, para os que são chamados, tanto judeus como gregos, lhes pregamos a Cristo, poder de Deus e sabedoria de Deus.
25 Bikos God foolishness wise pass all di sense wey human being get and God weakness strong pass all di pawa wey dem get.
25 Porque a loucura de Deus é mais sábia do que os homens; e a fraqueza de Deus é mais forte do que os homens.
26 My brodas and sistas, make una remember how God koll una, nor bi bikos una wise, strong or get money well-well.
26 Porque vede, irmãos, a vossa vocação, que não são muitos os sábios segundo a carne, nem muitos os poderosos, nem muitos os nobres que são chamados.
27 But God choose wetin di world tink sey dey foolish and weak, so dat wise and strong pipol go shame.
27 Mas Deus escolheu as coisas loucas deste mundo para confundir as sábias; e Deus escolheu as coisas fracas deste mundo para confundir as fortes.
28 Wetin di world tink sey nor good, naim God choose; tins wey dem tink sey nor mean anytin, na doz tins E make important.
28 E Deus escolheu as coisas vis deste mundo, e as desprezíveis, e as que não são para aniquilar as que são;
29 God do like dis, so dat nobody go fit boast for en front.
29 para que nenhuma carne se glorie perante ele.
30 Una don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness and holiness wey kom from God;
30 Mas vós sois dele, em Jesus Cristo, o qual para nós foi feito por Deus sabedoria, e justiça, e santificação, e redenção;
31 bikos, God word sey, “Anybody wey won boast, make e use Christ take boast.”
31 para que, como está escrito: Aquele que se gloria, glorie-se no Senhor.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Coríntios 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.