1 Coríntios 14

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Na love suppose guide una. So make una dey fight to get di gift wey di Holy Spirit dey give, especially di gift to profesai.
1 Segui o amor e procurai com zelo os dons espirituais, mas principalmente o de profetizar.
2 Bikos if una dey tok with difren-difren language wey odas nor undastand, God go undastand wetin una dey tok, aldo know oda pesin go know wetin e mean. Tins wey una go dey tok about, na only di Spirit go fit undastand dem.
2 Porque o que fala língua estranha não fala aos homens, senão a Deus; porque ninguém o entende, e em espírito fala de mistérios.
3 But wen una profesai, pipol go undastand una and odas go help una. Dem go get konfort kon dey okay.
3 Mas o que profetiza fala aos homens para edificação, exortação e consolação.
4 Pesin wey dey tok with difren language, dey help ensef. But di one wey dey profesai, dey help di church.
4 O que fala língua estranha edifica-se a si mesmo, mas o que profetiza edifica a igreja.
5 I for like make all of una dey tok with difren language, but I wont make una dey profesai. Bikos profesy go do una more good, dan sey una dey tok with difren language wey pipol nor fit undastand, unless somebody esplain di meaning give di pipol for di church.
5 E eu quero que todos vós faleis línguas estranhas; mas muito mais que profetizeis, porque o que profetiza é maior do que o que fala línguas estranhas, a não ser que também interprete, para que a igreja receba edificação.
6 My brodas and sistas, wetin una go gain if wen I kom, I dey tok with difren language wey una nor undastand and I nor esplain am? How I go fit help una den, unless I tell una wetin God tell mi or make una know wetin dem profesai and tish?
6 E, agora, irmãos, se eu for ter convosco falando línguas estranhas, que vos aproveitaria, se vos não falasse ou por meio da revelação, ou da ciência, ou da profecia, ou da doutrina?
7 If all music instrument get di same sound, how una go take know di one wey bi trumpet or harp?
7 Da mesma sorte, se as coisas inanimadas que fazem som, seja flauta, seja cítara, não formarem sons distintos, como se conhecerá o que se toca com a flauta ou com a cítara?
8 If trumpet make sound wey pipol nor undastand, who go dey ready to go fight war?
8 Porque, se a trombeta der sonido incerto, quem se preparará para a batalha?
9 Na so e bi wen una dey tok with difren-difren language wey pipol nor undastand. If nobody fit undastand wetin una dey tok about, dat mean sey na breeze una dey follow tok.
9 Assim, também vós, se, com a língua, não pronunciardes palavras bem inteligíveis, como se entenderá o que se diz? Porque estareis como que falando ao ar.
10 Dis world get difren language and all of dem dey good.
10 Há, por exemplo, tanta espécie de vozes no mundo, e nenhuma delas é sem significação.
11 But if odas nor undastand wetin una tok, den dem go bi like strenjas to una.
11 Mas, se eu ignorar o sentido da voz, serei bárbaro para aquele a quem falo, e o que fala será bárbaro para mim.
12 Na so e bi with una too. If una really wont di gift wey di Spirit dey give, make una choose di one wey di church go gain from.
12 Assim, também vós, como desejais dons espirituais, procurai sobejar neles, para a edificação da igreja.
13 So wen wi tok with difren-difren language wey odas nor undastand, make wi pray make God give us di pawa to esplain wetin e mean.
13 Pelo que, o que fala língua estranha, ore para que a possa interpretar.
14 For ezample, if I pray with language wey nobody undastand, my spirit dey pray, but my mind nor undastand di tins wey I dey pray for.
14 Porque, se eu orar em língua estranha, o meu espírito ora bem, mas o meu entendimento fica sem fruto.
15 So wetin I go do? Bikos e get time wey I go pray with my spirit and time wey I suppose pray with my mind. Sometaim, I suppose sing with my spirit and oda time, I go sing with my mind.
15 Que farei, pois? Orarei com o espírito, mas também orarei com o entendimento; cantarei com o espírito, mas também cantarei com o entendimento.
16 If some strenjas dey for where una for dey woship God for spirit and dem nor undastand una, how dem go take know wen to sey, “Amen”?
16 Doutra maneira, se tu bendisseres com o espírito, como dirá o que ocupa o lugar de indouto o Amém sobre a tua ação de graças, visto que não sabe o que dizes?
17 Una fit really dey woship God well-well, but nobody go gain from am, bikos dem nor undastand wetin una dey tok.
17 Porque realmente tu dás bem as graças, mas o outro não é edificado.
18 I tank God sey I dey tok with difren-difren language pass all of una.
18 Dou graças ao meu Deus, porque falo mais línguas do que vós todos.
19 But wen I dey church, e betta make I speak five betta words to tish odas, dan to speak 10,000 words wey pipol nor undastand.
19 Todavia eu antes quero falar na igreja cinco palavras na minha própria inteligência, para que possa também instruir os outros, do que dez mil palavras em língua desconhecida.
20 My brodas and sistas, make una stop to tink like small shidren. Instead make una dey tink like mature pipol and dey innocent like pikin wey dem just born.
20 Irmãos, não sejais meninos no entendimento, mas sede meninos na malícia e adultos no entendimento.
21 God word sey: “I go use strenjas wey dey speak wetin odas nor undastand, take tok to my pipol. Dem go tok to dem with strenj language, but my pipol nor go listin to mi.”
21 Está escrito na lei: Por gente doutras línguas e por outros lábios, falarei a este povo; e ainda assim me não ouvirão, diz o Senhor.
22 So, language wey odas nor undastand, fit mean sometin to pipol wey nor bilive, but nor bi to pipol wey bilive.
22 De sorte que as línguas são um sinal, não para os fiéis, mas para os infiéis; e a profecia não é sinal para os infiéis, mas para os fiéis.
23 So if di whole church bigin tok with difren-difren language, den some pipol wey bi unbilivers or doz wey nor undastand kon waka enter di church, dem nor go tink sey all of una don dey kraze?
23 Se, pois, toda a igreja se congregar num lugar, e todos falarem línguas estranhas, e entrarem indoutos ou infiéis, não dirão, porventura, que estais loucos?
24 But if evribody dey profesai and unbilivers or pipol wi nor undastand enter di church, dem go know sey dem bi sinnas and dem go won turn from dia sin kom meet God, bikos of wetin una dey tok.
24 Mas, se todos profetizarem, e algum indouto ou infiel entrar, de todos é convencido, de todos é julgado.
25 Den God go tell una di sekret wey dey dia heart. Den dem go knee down kon tell God sey, “Wi don really bilive sey yu dey with dis pipol.”
25 Os segredos do seu coração ficarão manifestos, e assim, lançando-se sobre o seu rosto, adorará a Deus, publicando que Deus está verdadeiramente entre vós.
26 My friends, wen una gada to woship, una must do evritin to help one anoda. Na so e suppose bi wen somebody dey tish, sing, profesai, tok with difren-difren language or dey esplain wetin di pesin tok.
26 Que fareis, pois, irmãos? Quando vos ajuntais, cada um de vós tem salmo, tem doutrina, tem revelação, tem língua, tem interpretação. Faça-se tudo para edificação.
27 Wen una dey togeda, make e nor pass two or three pipol wey go tok with difren-difren language wey pipol nor undastand. One pesin go tok, before anoda and make pesin dey, wey go esplain give odas wetin di pesin dey tok.
27 E, se alguém falar língua estranha, faça-se isso por dois ou, quando muito, três, e por sua vez, e haja intérprete.
28 If nobody dey wey go fit esplain wetin yu dey tok, make yu nor tok at-all for di meetin, but yu fit tok am between yu and God.
28 Mas, se não houver intérprete, esteja calado na igreja e fale consigo mesmo e com Deus.
29 Two or three pesin fit profesai and evry oda pesin must listin well-well.
29 E falem dois ou três profetas, e os outros julguem.
30 And if one among di pipol wey sidan receive message from God, di pesin wey dey tish must stop make di pesin for tok.
30 Mas, se a outro, que estiver assentado, for revelada alguma coisa, cale-se o primeiro.
31 Make di pipol nor tok at wons, so dat all of una go learn sometin and una go dey okay.
31 Porque todos podereis profetizar, uns depois dos outros, para que todos aprendam e todos sejam consolados.
32 Pesin wey bi profet must dey ready to stop, so dat anoda pesin go tok, bikos profet suppose to fit kontrol en own spirit,
32 E os espíritos dos profetas estão sujeitos aos profetas.
33 bikos God wont make dem do evritin well.
33 Porque Deus não é Deus de confusão, senão de paz, como em todas as igrejas dos santos.
34 make wimen nor dey tok. Make dem kwayet dey listin, just as Moses Law tish.
34 As mulheres estejam caladas nas igrejas, porque lhes não é permitido falar; mas estejam sujeitas, como também ordena a lei.
35 If dem won know about sometin, dem fit ask dia husband wen dem rish house. Bikos na disgrace for woman to tok for church.
35 E, se querem aprender alguma coisa, interroguem em casa a seus próprios maridos; porque é indecente que as mulheres falem na igreja.
36 God message nor start with una and nor bi only una don hear am.
36 Porventura, saiu dentre vós a palavra de Deus? Ou veio ela somente para vós?
37 If una dey tink of unasef as profet or pesin wey di Spirit dey use, den una go know sey I dey rite only di tins wey God kommand mi.
37 Se alguém cuida ser profeta ou espiritual, reconheça que as coisas que vos escrevo são mandamentos do Senhor.
38 So make una nor listin to anybody wey nor bilive wetin I dey rite.
38 Mas, se alguém ignora isso, que ignore.
39 My friends, make una dey try to profesai and make una nor stop anybody wey dey tok with difren-difren language even doh odas nor undastand wetin e dey tok.
39 Portanto, irmãos, procurai, com zelo, profetizar e não proibais falar línguas.
40 But make una dey do tins as e suppose to bi.
40 Mas faça-se tudo decentemente e com ordem.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Coríntios 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.